The forest was thick and
dark, an owl hooted at the far side of the bushes as it gazed at me from the
branch of the tree. My legs had begun to ache and my eyes teared up a little
when I realized that I wasn’t close to Lagos at all, instead I had ended up
walking further into the bushes. Stamping my foot on the ground like a spoilt
child, I cry;
“No be direction I follow
so? Why I dey enter inside bush na? Na wetin be dis one wey pesin don land
herself so? Lagos! Lagos! If you kno say you no want Senorita, talk am now ooo!
Lagos shebi you dey hia me so?” I shout, my hand tugging my left ear in a form
of warning.
“Lagos want u….” A
creepy voice said behind me.
I startled and turned to
face the intruder, it was a man so short that I had to bend to look at him.
“Who be you?” I ask.
“Lagos.” He replied.
“You? Lagos?” Despite my
present state, I laughed loud and hard.
“Wetin dey make you
laugh? No be you dey call me?” The man called Lagos asked.
“Why I go dey call you?”
I ask.
“I hear Lagos for ya
mouth now now…” He replies.
“Na you be Lagos?” I ask
getting annoyed.
The man looked at me for
an instant and threw his head back in laughter. This singular action of his
made me angrier as I hissed and started walking away.
“Wia you dey go?” He
asked me.
“Lasgidi ofcourse!” I
replied.
“Whish one be Lasgidi…
no be Lagos u dey so.”
I hiss and continue
walking away when I feel a magnetic pull fasten me to the ground, I struggle
frantically and try hard to release myself but the more I get fastened.
“Wetin you dey do me so?
Who be you? You don use charm catch me for hia abi?” I scream.
He walks up to me and
stands right before me, smiling and smirking in delight.
“Run na….wia you be wan
run go?”
“Release me…you be
witch?” I shout.
“You no see sign board
for road? D sign board talk; ‘LAGOS A PLACE OF NO RETURN’ abi you no dey see
road?”
“Na lie…I no see lagos a
place of no return…wetin I see be ‘This way to Lagos.’” I retort.
“Heeheehaa…you don reach
de Lagos wia you dey find, why you dey shout now?”
“Lagos na place wia
pesin dey live.” I spit at him and look at
bush irritatingly. “This no be Lagos”
“Omoge…dis place na
Lagos and my name be Lagos. You dey call my name wen you enter dis place and
you go live hia with me. Shebi you grab?”
“Ahh lai lai…I no fit
live for dis bush! A whole Senorita wey dey ready to paint Lagos to sure levels…I
no fit live hia.”
“See ya mouth…chai…I get
luck sha…see fine girl wey enter my dormot so.” The man said smacking his lips
and wagging his tongue.
“Kai…no touch me! No use
dat ya hand touch my fine body…” I warn.
“If I touch am nko?
Wetin you go do?”
“Touch am na…touch am…if
my mama and her witch people no go kee you for hia.”
“Hehehe omoge…abeg I wan
see ya mama…I fit even take opportunity ask am make I marry you.”
He reaches out and
touches my hand and I cringe, then his beefy palms caress my face. ‘This is not
what I want for myself’, I scream inwardly, ‘what have I got myself into?’
“Mama! Make you come
save ya pikin now ooo.” I scream loudly, knowing fully well that my mother is
no witch and I was just trying to fool him.”
The man’s eyes lit up
and he starts dancing around in circles, singing loudly and chanting in a tongue
too difficult to understand.
“Mama! Mama!” I screamed
and coughed.
“Dis one wey me and
witch go fight today…abi you don see babalawo and witch wen dem dey fight? Na
me go kee ya mama.” The man said laughing in glee.
I had to stop deceiving
myself, my mother would be at the village either sleeping or warming her legs
by the fire, the poor woman had never seen witchcraft before and was always
terrified of hearing witchcraft tales.
“Oga abeg release me…make
I go…na dokitor I find come abeg.” I plead.
“You no call ya mama
again?”
“No…e be like say she
don sleep.”
“Ahh…witch dey sleep
again?
“No…I mean…dem dey
sleep. She fit don fly tire for aftanun. Abeg oga make I go….na doki I find
come.”
“Me sef I be doki” The
man said.
“No be dat kind…I dey
talk about dockitor…dat one wey dey hospital for Lagos.”
“Close ya mouth…e no get
dockitor wey big pass me.” He said.
I feel like dying
because for the first time in the last hour, I know that I am trapped and can
do nothing about it. I had been smart all along until now, I had outsmarted the
419 gang who had initially created a façade with the modeling agency, I had
escaped from my madam’s house, the prison, psychiatric facility, the booth of
the driver’s car but now, in the space of one hour, I have managed to be
trapped by one man who’s head hardly measured above my knees.
“Oga abeg make I go…dis
no be Lagos na…oga abeg.”
“You go go.” The man
replied.
“Thiank you sir.” I
answer gratefully still trying to release myself from the invisible grip
holding me down to the ground.
“But you go do something
for me…” The man supplied.
“Anything sir…”
“You go born pikin for
me after you don born finish, I go release you.”
My eyes widen in shock
and turning my gaze to face the sky, I shout.
“Baba wey dey up…I don
enter kurukere waka and na only you fit hia me…abeg come down!”